Connect with us

International News

TB Joshua burial: Prophet TB Joshua corpse arrive Synagogue Church of All Nations – In photos

Published

on

Temitope Balogun Joshua, Nigerian preacher, televangelist, and founder of di Synagogue Church of All Nations die on 6 June, 2021

Synagogue Church of All Nations (SCOAN)
 
Wetin we call dis foto,

Everything don set for di Lying in state of Prophet TB Joshua for di Synagogue Church of All Nations (SCOAN). Di televangelist, and founder of di church die last month at di age of 57

 
Candle light procession
 
Wetin we call dis foto,

Di week-long programme bin start wit candlelight procession wey witness at least 5000 followers of di late prophet TB Joshua wey die last month. Pipo from far and wide both black and white na im attend di procession.

 
Pipo beging gather for di lying in state
 
Wetin we call dis foto,

As early as 8am pipo begin arrive di church venue for di lying in state wey don start. Attendees go through Covid protocol before dem enter di church.

 
Dem dey take Covid-19 protocol serious
 
Wetin we call dis foto,

Di Church ensure say dem follow di Covid-19 protocol of Lagos state goment. Di team from Lagos state goment bin carry out inspection wit Incident Manager of Emergency Operation Centre of Lagos Covid Response, Dr. Ismail Abdul Salam part of di inspection team wey bin visit di church over di weekend.

 
TB Joshua family for day of tributes

Wia dis foto come from, Emmanuel TV/Facebook

 
Wetin we call dis foto,

Day two of di funeral ceremony of di prophet na day of tributes wia members of di family for dia tribute say though dem experience trial and test as a family but say dem survive am.

 
Nigeria singer, Timi Dakolo

Wia dis foto come from, Emmanuel TV/Facebook

 
Wetin we call dis foto,

On Wednesday, di church hold all night praise session. Gospel artistes from across di world including Nigeria singer, Timi Dakolo perform for di praise concert.

 
Casket wey Prophet TB Joshua arrive di Church mountain
 
Wetin we call dis foto,

Di Lying in state start from di ‘church mountain’. Na dia di Casket wey Prophet TB Joshua dey inside first arrive

 
Di vehicle wey carry Prophet TB Joshua casket
 
Wetin we call dis foto,

Dignitaries begin escort di vehicle wey carry Prophet TB Joshua casket go church for di Lying in state proper

 
Pipo dey buy and sell sourvenirs of TB Joshua Photo
 
Wetin we call dis foto,

Di burial ceremony of TB Joshua dey like carnival as pipo dey buy and sell souvenirs wey carry di Prophet photo. Ikotun area of Lagos wey dey host di Synagogue church dey like tourist centre as pipo from all over di world enter di area for di burial.

 
Woman wey dey express deep sadness
 
Wetin we call dis foto,

Men, women, children dey express deep sadness about di death of di founder of di Synagogue church of All Nations. All categories of pipo gather for di lying in state of Prophet TB Joshua.

 
Hundreds of pipo join di procession
 
Wetin we call dis foto,

Di entourage wey follow Prophet TB Joshua procession from di ‘Church mountain’ to di main auditorium of Synagogue include plenty members of di Ikotun community and visitors from abroad.

 
Pipo dey try to gain entrance into SCOAN

Wia dis foto come from, BBC Sport

 
Wetin we call dis foto,

Hundreds of pipo gather outside di Synagogue church of All Nations to gain access into di church make dem fit pay dia respect to di Late Prophet. Some also dey dia to witness di funeral but di tight security dey try to manage di crowd. Di Lagos state Emergency agency also dey on ground to avert emergencies for di place.

 
Photo gallery of Prophet TB Joshua
 
Wetin we call dis foto,

Inside di church wey di Lying in state dey happen get ‘Photo gallery’ wey show all di activities of Prophet TB Joshua in most part of di world wen im bin dey alive.

 
Photo of man wey dey sad
 
Wetin we call dis foto,

Before im death plenty pipo believe say Prophet TB Joshua dey popular for philanthropy, wey mean say im dey sabi give pipo tins. Dis na member of di community wey dey sad sake of di death of di televangelist.

 
Crowd outside SCOAN
 
Wetin we call dis foto,

As di lying in state dey go on inside SCOAN hundreds of pipo still gather outside to get a feel of wetin dey happen inside. Di crowd wey don dey dia since morning dey cooperate wit enforcement officers.

 
TB Joshua inside transparent class
 
Wetin we call dis foto,

Dem majestically position di corpse of Prophet TB Joshua inside di Synagogue Church of All Nations wit strict obedience to Covid19 protocols. Di corpse dey inside transparent glass wey make everybody fit see di body even from far.

 
Faces of pipo wey dey cry for TB Joshua Lying in state
 
Wetin we call dis foto,

Many pipo wey attend di Lying state of Prophet TB Joshua come from all over di world. Many of dem no fit hold dem sef as tears flow freely while odas lament sey dem go miss di preacher.